October 6, 2024

Ghana vs Egypt: Mohammed Kudus start for Black Stars against Pharaohs

Ghana #Ghana

Wia dis foto come from, Getty Images

18 January 2024, 12:17 WAT

New Informate one hour wey don pass

Ghana and Egypt playout entertaining 2-2 draw as both countries share one point each for dia second group match of di 2023 Africa Cup of Nations.

Afta a quiet opening to di match, Mohammed Kudus strike just before half-time give di Black Stars di lead.

Seven-time winners of di competition Egypt task to grab dia first win for dis Afcon come dey hard as dia captain Mohamed Salah bin exit di match due to injury just before Ghana open di scoring.

Di Pharaohs later equalise just afta di hour mark as Omar Marmoush pounce on shot back pass by Inaki Williams to round di goalkeeper.

Dia equalise last only 103 seconds as Mohammed Kudus grab im second wen im shot inside di area deflect into di net.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Kudus bin miss Ghana first group match against Cape Verde

Wen you tink Ghana go hold on, again dem gift Egypt a lifeline. Trezeguet steal di ball from substitute Osman Bukari before im cross am for Mostafa Mohamed to toe poke di ball into di net for 2-2.

Di draw leave four-time Afcon champions Ghana wit only one point afta two games. Egypt on di oda hand don draw dia opening two matches meaning say dem get two points.

Both teams must win dia last group match for dem to stand any chance of qualifying to di knockout stages.

Ghana go meet Mozambique for dia last match while Egypt wey go dey sweat on di fitness of Salah go face Cape Verde.

Second half

90+6 mins – Egypt go close to scoring di winner, Ashour place im shot just for di edge of di area. Ofori save di ball well.

90 mins of play don dey up, referee add seven more minutes for any of dis teams to find di winner.

89 mins – Ghana make two substitutions. Paintsil and Owusu come on for Bukari and Abdul-Samed.

Egypt also bring on Attia for Marmoush.

83 mins – Egypt dey boss tins now as na dem dey control di possession of di ball.

Afta dat action wey lead to goals di game don calm down now.

74 mins – Egypt score again! Dis game don go crazy. Three goals inside five minutes. Dis time na Mostafa Mohamed wey poke di ball inside di net afta substitute Bukari give di ball away

71 mins – Kudus give Ghana di lead! Di West Ham man bend im shot wey take small deflection straight into di net. Ghana provide quick response to Egypt equaliser.

69 mins – Goal for Egypt. Omar Marmoush pounce on Williams shot backpass, dribble past di keeper to equalise.

Wia dis foto come from, Getty Images

68 mins Egypt don take off Elneny, Trezeguet don enter di game as im replacement.

66 mins – Antoine Semenyo race into Egypt half after e receive one through pass. Di Bournemouth foward try to bend e shot round di defender but di shot lack power.

65 mins – Omar Marmoush send anoda shot high into di stand. Egypt don begin create chances afta dem get only one shot for di first half. Dem don record four already inside 20 mins since di game restart.

62 mins – Ashimeru don exit di game, Idrissu Baba don take im place.

58 mins – Egypt don increase di tempo of di game. Dis time Ofori tip over Fathi powerful strike, di ball go out for corner. From di corner Abdelmonem head di cross go out for goalkick.

57 mins – Fathy go past Odoi like say im no dey dia vefore im send e cross in for Mostafa Mohammed. Ofori rush out of im goal to catch di ball.

52 mins – Egypt get di equaliser, o wait. Di ref say no goal. VAR go check am.

Abdelmonem tap di ball into di net afta Ofori parry am into e path.

Afta checks by VAR dem say di goal no go stand as an Egyptian player bin dey offside in di buildup to di goal.

49 mins – Ghana don start di first half very well.

First Gideon Mensah overhit im cross den Kudus again shoot wit im right from a corner. Di shot bounce for ground come loop over everyone before im land ontop di net.

46 mins – Ghana restart di second half wit one goal lead. Egypt need to find anoda source for dia goals afta Mohammed Salah go off wit injury for first half.

First Half

1 min – Di game don start, Egypt na dem take di opening kick. Both sides need di three points afta dia disappointing start for dia first match. Ghana lose 2-1 to Cape Verde while Egypt draw 2-2 wit Mozambique.

3 mins – Kudus wey miss Ghana first match don begin show why im dey important to dis side. Di West Ham player try one shot from outside di box afta im hold off im marker, im shot dey deflected into di arms of El Shenawy.

5 mins – Majeed Ashimeru dribble im way through di Egyptian defence before im knack through pass towards Semenyo. Di forward just dey offside and di linesman end di move wit im flag.

13 mins – Ghana so far don show ginger. Jordan Ayew try to dance im way inside di box but im run fast past di ball. Egypt clear well.

19 mins – Omar Marmoush go down inside di penalty, di ref blow against am instead. Egypt captain Salah no dey happy wit di decision as im begin change am for di referee.

25 mins – Ghana wit beautiful touches see Ayew dribble past im marker down di right before im try to feed di ball to Kudus. Hegazy track back well and slide to win back di ball for Egypt.

30 mins – Denni Odoi dey lucky see im no receive yellow card afta im hold Marmoush shirt come bring am down.

No real opening so far for dis crucial game.

Maybe di cooling break weu dem dey on now go give di coaches chance to talk to dia players and change tactics.

38 mins – Yellow card for Abdul Samed, di mifielder block Marmoush from running to dangerous area. Di freekick from Marmoush dey poor as e no pass di first defende

43 mins – We finally see di first shot on target for dis game. Kamal send a cross into di box, Ghana clear well but di ball fall to Ashour. Im control am before im shoot, di shot no hot as Ofori catch am well.

45+1 mins – Mo Salah don come off e be like na sake of injury as di Liverpool man don hand di captain armband to Hegazy. Fathi don come on to replace am.

45+3 Goal! Ghana take di lead through Mohammed Kudus.

Di forward waya better shot from outside di box straight into di net.

Egypt vs Ghana lineup

Egypt XI: El Shenawy, Kamal, Hegazi, Abdelmonem, Hamdy, Fathi, Elneny, Ashour, Marmoush, Mohamed, Salah

Ghana XI: Ofori, Odoi, Djiku, Salisu, Mensah, Ashimeru, Samed, Semenyo, Kudus, Ayew, Williams

Leave a Reply