September 21, 2024

BebeCool: Tems accuse Uganda musician of making police arrest her and Omah Lay

Bebe #Bebe

19 December 2020, 06:56 WAT

New Informate 7 hours wey don pass

Nigeria singer, Tems wey don accuse Uganda artist, Bebe Cool on top twitter say im allegedly dey behind her arrest for Uganda.

Dis strong accusation dey come days afta Uganda police release di artist alongside Omah Lay to Nigeria goment afta dem gbab dem for breaking coronavirus rules for di kontri.

Uganda Police bin don charge Stanley Omah Didia alias Omah Lay, Temilade Openiyi alias Tems, plus one oda Nigerian Muyiwa Awoniyi wit offence of “negligently doing acts wey fit spread infectious diseases”.

Tems, for inside tweet on Friday, accuse Bebe Cool say na him call police to arrest dem.

“You call police on us, YOU get us arrested”, she allege.

“Your friend break enta our room and carry us afta you call, only for me to see you for di DPO office dey laugh, dey relax wit am,” she add.

Na true say Bebe Cool ask police to arrest Tems and Omah Lay?

Di Uganda artist neva respond to dis accuse.

Wetin we sabi be say, for one Facebook post wey im allegedly put out, Cool bin wonder why di organisers of di concert go prefer to bring two Nigerian artistes wen many of im colleagues for Uganda bin dey struggle financially due to Covid-19 restrictions.

He bin ask make dem cancel di concert. “Make I hope say dis na because if na real, I go make every effort to fail di event,” im write for dat post.

Wen Uganda police later release di Nigerian artists from jail, Bebe Cool enta twitter to show say im dey happy.

Im enta twitter on 15 December to show court papers wey order di release of di three Nigerians.

He caption di tweet “Great news, dem don dey free” and he also tag Omah Lay and Tems for inside di tweet.

Di document wey im post also torchlight say na one Kigo Prison dem bin keep dem put.

Im also call Omah Lay im younger brother for anoda tweet wey follow.

“My younger brother don comot from jail”, he tok.

How di arrest take happun?

Di two musicians been perform for one event for Kampala on Saturday 12 December 2020 wey authorities claim say break coronavirus rules.

Omah Lay tweeted say him “just be singer wey dey try to entertain” and call on Nigeria ministry of foreign affairs to intervene for di mata.

Goment for Uganda bin suspend social gatherings including – controversially – election campaign rallies, to reduce di spread of di virus.

Leave a Reply